11 Apps wey fit borrow you money without BVN for Naija

11 Apps wey fit borrow you money without BVN for Naija

Find beta way wey no get stress to borrow money for Naija with dis top loan apps like FairMoney, Cowrywise, Okash, JumiaPay Nigeria, Alat By Wema App, GTBank, Branch, Kwikmoney, PalmCredit, Carbon, Aella, wey no need BVN. Check their levels, compare their interest rates, then pick the one among the “apps wey fit borrow you money without BVN for Naija” wey go waka well with your financial matter. We dey carry your privacy for head!

To borrow money from apps wey dey ask for BVN fit dey somehow for Nigerians wey get trust wahala, because dem fit dey reason say their BVN info fit leak and the money for the different accounts wey dey linked to the BVN no go dey safe.

If na so e be for your side, no worry, we get your back. We go provide apps wey BVN no dey compulsory, so that you sef fit relax your mind when you dey borrow money. For those wey dey reason wetin BVN fit be, abeg, we still get your back.

Wetin be BVN?

BVN, wey be Bank Verification Number, na to grab pesin biometric data like fingerprints and face, join am with unique number wey dey identify the person. Na system wey Central Bank of Nigeria put in place to identify individuals for inside banking system and reduce thief-thief, scam, 419 and other bad tins.

Why BVN dey important for loan matter?

BVN dey make loan application waka easy, because e dey give financial institutions one kind standard ID wey dem fit use check person details sharp-sharp, to make sure say no be another person dey form another person. Oya follow us check apps wey fit borrow you money without BVN for Naija;

11 apps wey fit borrow you money without BVN

FairMoney 

Out of all the apps wey fit borrow you money without BVN for Naija, FairMoney na the oga kpata kpata. Dem fit just arrange 300k for you now now now without your BVN. And their interest rate dey okay, no be like other apps. Forget, dem dey try, only say if you no pay back on time, dem fit use call spoil your phone for you.

11 Apps wey fit borrow you money without BVN for Naija11 Apps wey fit borrow you money without BVN for Naija

Cowrywise

I bin dey think say Cowrywise app na just for saving money, earning interest, and investing. But omo!, e no end there o! You fit also get loans from am. Yes, loans! E no sha simple as e sound. E get more tori wey dey inside. No need for BVN, of course. But na the kind of mutual funds wey you don invest your money and where you wan borrow from go determine how much loan you fit collect.

So, when you dey ask bank or any money place for loan, your mutual fund units na like your collateral. Dem dey act like security, dey talk say, ‘If I no fit pay back the loan, you fit take control of these mutual fund units to cover the amount.’ E be like backup plan, e come follow for apps wey fit borrow you money without BVN for Naija.

Okash

You see ehn, Okash loan app, wey be Opay digital banking app brother, na one app wey fit borrow you money without BVN for Naija dey give loan for Naija. Just the other day, I fill form sharp sharp, and before small time like this, the money land for my account in less than one hour. You sef fit borrow like 50k without this BVN thing, but I no go sha lie you, their interest rate low.

JumiaPay Nigeria

Jumiapay dey spread well-well for business o, dem get one of the biggest shopping platforms for Africa, and na dem still get this app wey be one the apps wey fit borrow you money without BVN for Naija. JumiaPay services dey cover buying of airtime, paying for TV subscriptions, and other other bills. Among all dis things, dem dey still offer sharp-sharp loans wey fit reach 100k and BVN no go lap.

Alat By Wema App

This bank just be like Cowrywise, na Nigeria’s first ogbenge digital bank wey everybody dey yarn about. You fit save and invest inside and still fit collect loans. You see these guys ehn, dem fit quickly disburse loan of up to 2Metres give person without BVN, collateral, or paperwork. I no sabi as dem dey take run am o. True true, na loan app wey follow for apps wey fit borrow you money without BVN for Naija

GTBank

Some of una for this Naija wey be GTBank customers no sabi wetin God do for una sha. GTbank, wey him bank app dey among apps wey fit borrow you money without BVN for Naija, na the only bank for this country wey nor too get kasala, except if other banks don dey corrupt am small small. But no wahala, no be wetin carry me come be that. GTBank na one of the few commercial banks for this country wey dey give people loan without BVN, dem dey try well-well.

Branch

For inside Branch, you fit transfer money to earn, and invest to earn, but dem no go give you shishi say you borrow money, lol, no mind me. Branch na another Nigerian online banking platform wey person fit collect up to 200k with other personal information and bank statement without BVN, come still fit pay back in like 6 months. This na one app wey fit borrow you money without BVN for Naija wey be sure plug.

Kwikmoney

If dem talk say people no sabi dis app, e no mean say e no dey useful. Kwikmoney interest rate dey very competitive and the application process easy. You fit apply for loan of N1 million without BVN, Yes, na so e easy reach. Na Kwikmoney be one app among apps wey fit borrow you money without BVN for Naija wey get flexible repayment terms with no collateral needed, na dis app be baba abeg.

PalmCredit

As you hear PalmCredit so, you fit dey think say na division of PalmPay company, me sef bin dey reason am like dat. Even though dem get the same name for the beginning, dem be different companies. Inside PalmCredit, you fit borrow small money, but no money small reach wey no fit solve any problem, walai. Dem fit give you from 10k to 200k without needing BVN, and their interest rate no too high, reason am now.

Carbon

This Carbon app dey very popular o. No Nigerian fit count loan apps or even apps wey fit borrow you money without BVN for Naija without mentioning this one, maybe because dem dey treat people wella. Carbon app fit give loans wey range from 1.5k to 1 meters without your BVN. E be one-in-all app for money management.

Aella

For inside apps wey fit borrow you money without BVN for Naija, Aella na the last one I go talk about. This Aella dey do plenty things, you fit use am pay bills, invest, transfer money, and even get instant loans. For inside here, person fit collect loan wey reach 1 million naira without stress and BVN, with interest rate from 2-20%. You see as e low, bah.

Final Talk

Abeg, make you sabi say even if these apps wey fit borrow you money without BVN for Naija no need BVN, sometimes dem fit still bring am as option when you dey fill form to get loan. You fit see am for some apps, but you get option to waka pass am, and you go still collect the loan. If you sabi other apps wey fit give people loan without BVN, abeg write am for the comment section to help another person.

 

 

Frequently Asked Questions

Which app dey legit to borrow money for Naija?

Legit apps wey person fit borrow money from for this Naija plenty yakpa, and most of them dey here.

E get any loan app wey no need BVN?

Yes o, na wetin we just talk about finish now now now. All the apps wey I mention for up no need BVN. No be say dem no go fit ask you for the app make you put am o, but e no dey compulsory.

How I fit collect loan within 10 minutes?

Loan apps wey I sabi wey fit give loans sharp-sharp na Okash, EasiMoni, and FairMoney. So if your body dey hot and you no fit wait for long, just use any of the 3 apps wey I don mention, dem dey deliver in less than 10 minutes sef.

I fit borrow money from Opay?

  • Dial *955# with the phone number wey you use register your Opay account.
  • Select the option wey talk “loan”.
  • Follow the instructions wey dem go give you until your loan arrive.

                                                                                    Or

If your Opay app dey updated;

  • Waka go your dashboard, you go see loan option, click on am.
  • E go carry you go EasiMoni loan (dem and Opay dey affiliated)
  • Fill in wetin dem ask you.
  • The loan go land inside your Opay account.

How much be OKash first loan?

Na from 3k to 5k with interest rates wey dey between 0.1% to 1% daily.